Saturday, 4 October 2014

8 Signs That You Are A MUGU


1:na mugu you be if you dey pay for a babe school fees or house rent way you never even do introduction.


2:u be mugu if the money meant 4 ur pickins school fees u carry all the money take am buy brazilian wigs and expensive BBs for ur girlfriend or girlfriends

3:u be mugu if u steal ur papa money take am buy mary kay,bleaching cream,lip stick and other expensive gift items for ur babe on valentine day

4:in short u be mumu,malumalu,olodo,agbaya,ewu,cow etc if u and ur paddys dey rob bank or stand for highway with guns dey rob motorists just becos una wan impress una girlfriend wit money

5:u be mugu plus woman wrapper if u dey wash ur babe dirty pants and bra(eg sexkillz)

6:na mugu u be if u dey go market for a babe

7:u be mugu if the small money wey u dey earn as salary instead of u to use the money maintain ursef and ur family u dey take the money train one small girl for school with the hope say u go marry her after she graduate.omo wise up my girl many mumu men don already commit suicide becos the girls wey dey train for school don dump dem on the marriage alter 

8:u be mumu if the main reason wey u dey do yahoo yahoo na to impress a babe with money.

You can had your in the comment box plz.....

0 comments:

Post a Comment